Di messenja give evribody for Israel and Judah, di king and di ofisas leta. Wetin di king rite for di leta na, “My pipol Israel, make una turn back kom meet Abraham, Isaak and Israel God, so dat E go kom meet una wey E save from Assyria kings.
Dis na di tins wey Hakalaya pikin, Nehemaya do. For di twenteth year, for Kislev mont, wen Atazazes bi king for Persia, mi, Nehemaya, dey Shushan, wey bi di palis.
Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.
Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.
Just as di king kommand, dem kon tok evritin for di main town for Shushan and di messenjas karry am go evriwhere for di kingdom. Di king and Haman dey drink and enjoy diasef, while evribody for Shushan town, dey run up-and-down.