Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”
Den Samson pray give God sey, “Oga God wey get pawa, remember mi again. My God! Abeg make Yu give mi pawa one more time. Make I pay Filistia pipol back for my eye wey dem blind.”