Wen doz days don komplete, di king do party for all di men wey dey Shushan, both di senior and di junior workers. Dem use seven days take do di party for di royal palis gardin.
Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.
Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”