10 Den di king tell Haman, “Make yu go kwik-kwik! Kollect di garment and horse, den do all dis tins wey yu tok for Mordekai, di Jew wey dey di palis gate.”
So Haman take di klot and di horse kon wear dem for Mordekai. Den e kon lead am thru di town dey shaut, “Make una si how di king dey reward di man wey e choose to honor.”
Den make one of di king men dress di pesin kon dey lead am thru di town as e dey on-top di horse. Make di king offisa dey shaut as dem dey go sey: ‘Make una si how di king dey reward di pesin wey e choose to honor!’ ”
Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
As e karry ensef up, dey enjoy yeye life, na so di sofa and sadnes wey yu go gi-am, go plenty rish, bikos e tok for en mind sey, ‘I dey rule like kween, my husband neva die and I nor go ever si sadnes again!’