One day wen Mordekai dey work for di palis gate, Bigtan and Teres wey bi ofisas wey dey guide di king door-mot kon dey vex and plan to kill King Zazes.
Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota bikos dia trot don dry, den mi, wey bi God go ansa dem. Israel God nor go ever abandon dem.
Den di pipol wey dey fear God kon tok to each oda and God listin and hear wetin dem tok. For God present, all doz wey dey fear and respet en name, dem kon rite dia name put for one book so dat God go remember dem.