8 If my oga really wont do wetin I go ask for, I go wont make yu and Haman kom di party wey I go do for una tumoro, den I go tell yu wetin I wont.”
Inside di royal palis, Kween Vashti sef dey do party for di wimen.
Haman still sey, “Na wetin remain? Even di kween do party for di king and na only mi e invite to follow am and e still sey make wi kom back tumoro.
Estha ansa, “Dis na wetin I dey ask and pray for:
So di king and Haman kon go chop with Kween Estha
Estha ansa, “Abeg! My king, if yu go agri with wetin I wont, den make yu nor allow dem kill mi and my pipol.”
“If di king like and kare about mi and if e dey good for yor eye, make yu kommand yor ofisas make dem nor do di tins wey Haman, Hammedata pikin, from Agag, rite about all di Jew pipol for di kingdom.
Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.