5 Den Estha koll Hatak, one offisa for di palis wey di king sey make e dey serve am kon send am go ask Mordekai, make e tell am wetin dey happen.
For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,
But wen di savant tell di kween wetin di king kommand, e nor gri kom. Dis tin kon make di king vex well-well.
den Estha sey make e go give Mordekai dis message:
Wen Estha savants tell am wetin dey happen, e vex well-well kon sey make dem go remove Mordekai sak klot kon wear am betta klot, but Mordekai nor gri.
Hatak go meet Mordekai for di town centre for di palis gate.
Hatak do as Mordekai tell am,
Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
If one part dey sofa, di oda parts dey sofa too. But if dem praiz one part, di oda parts go dey happy.
Make una nor dey tink about unasef alone and wetin una wont, but make una dey tink about wetin good for odas too.
Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.