6 and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.
Wen King Zazes start to rule, Judah enemies wey dey stay for Judah and Jerusalem kon go komplain against dem.
But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.
Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish and nobody go remember dem again.”
All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.
“Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.
So, heavens make yu happy! But wahala go happen for di eart and sea, bikos di devil don kom meet una with strong vexnashon and en time too short.”