Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Estha 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So for di thirtint day for di first mont, Haman koll di king seketry kon sey make e rite dis kommand for all di language for di kingdom kon send am go meet all di rulers, govnors and ofisas for di kingdom. Dem rite am with King Zazes name kon stamp am with en ring.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Estha 3:12
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Jezebel rite leta, sign am with Ahab name, use en seal take seal am kon send am go give di ofisas and doz wey bi leaders for Jezrel.


Dem still take di dokument wey di king give dem kon gi-am to di govnors and ofisas wey dey West Eufrates aria and dem too kon dey support di pipol and God Temple.


E send message go all di kingdoms for Persia and Media sey evry husband must bi di head for en house and na wetin e tok, dem must obey.


Di king tell am, “Make yu nor worry about di money, just go do wetin yu like with di pipol.”


Den di king remove en ring (di one wey e take back from Haman) kon gi-am to Mordekai. And Estha sey make Mordekai kare for Haman propaty.


Jew pipol kon make law for demsef, dia shidren-shidren and any oda pesin wey go turn to Jew sey, for di rite time for evry year, dem must observe dis two days akordin to wetin Mordekai rite.


Yu orda sey, wons wi hear di music dey play, evribody must bow kon woship di gold image


all of dem gada go meet di king kon tell am, “Awa king! Shebi yu sign orda sey for thirty days make anybody nor pray give human being or gods escept yu and yu sey who pray give any oda god, make dem trow am for lion pit?” Di king ansa, “Una dey korrect! E dey for Mede and Persia Law and dem nor go fit shange am.”


Daniel enemies tell di king, “Awa king! Yu know sey Mede and Persian Law sey, any orda wey di king give, nobody go fit shange am.”


King Darius kom rite give all di pipol, nashon and language wey dey di land sey: “I greet una!


Abeg, awa king, make yu give and sign dis orda, so dat nobody go fit shange am and e go bi like Mede and Persia Law wey nor dey shange.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ