King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.
God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.
I sey, “King Jekonaya go bi like pot wey break wey dem trowey. E go bi like klay pot wey pipol nor won use at-all. Why dem go force en and en shidren go anoda kountry? Wetin make dem won take dem go kountry wey dem nor know anytin about?”
Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.