King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.
So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.
For di third day, Estha wear en royal dress kon go stand for di inna kourtyard gate for di palis wey face di throne room and di king sidan for di throne.
E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere.