For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,
Di pipol wey e dey always koll for advise na: Karshena, Shetar, Admata, Tarshish, Meres, Marsena and Memukan and dem bi seven ofisas for Persia and Media wey get di highest pozishon for di kingdom.
Make yu choose ofisas for evriwhere for di kingdom sey make dem bring all di fine girls kom meet yu for Shushan wey bi di main town. Make Hegai kare and trit dem well, bikos na en dey take kare of yor wimen.