bikos na doz days Jew pipol take win dia enemies. Na den dia problem and wahala turn to smile and happiness.” Doz days go bi wen Jew pipol free diasef from dia enemies, so dem go share gifts among demsef and dash poor pipol gifts too.
So Jerusalem wimen, make una kom si King Solomon dey kom. E wear di crown wey en mama take crown am for di day wen e marry and na dat day, sweet pass for en life.
I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.
Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”
Ask yor savants and e go tell yu! Make yu favor yor savants, bikos na holiday wi kom for. Abeg make yu give yor savant and David anytin wey yu go fit give us.’ ”