Dem trit di girls well for one year, dem massage dem with myrrh oil for six monts and balsam oil for di oda six monts. Afta, dem kon dey take each girl go meet di king.
E go-go der for evening kon kom back for morning, den dem go take am go meet Shaashgaz wey dey kare for di king girl-friends. Di girl nor go-go meet di king again, unless di king like am kon ask of en name.