Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Estha 10:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Estha 10:3
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na yu go take kare of my house and all my pipol go obey yor kommand. Na only mi, di king go dey great pass yu.”


Una go dey for Goshen land and una go dey near mi; both una, una shidren, una grand-shidren, una animals and plants and evritin wey una get.


I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’


One soja for Efraim wey dem dey koll Zikri, kill di king son wey dem dey koll Maaseaya and Azrikam wey dey kare for di palis with Elkanah wey bi di kommander.


But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.


E get one Jew wey dey stay for Shushan and en name na Mordekai wey bi Jair pikin; e kom from Kish and Shimei family for Benjamin tribe.


Bikos of dis, all di king savants wey dey for di king gate kon dey bow and respet Haman, bikos di king don kommand sey make e bi like dat. But, Mordekai nor gri bow or gi-am respet.


Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”


Just as di king tok, dem kon wear royal purpol klot give Daniel; put gold shain for en neck kon make am di nomba three man for Babilon.


Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom.


My brodas and sistas, I dey wish and pray to God from my heart evriday sey, make God save dem wey kom from Israel.


If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.


But evribody for Israel and Judah like David, bikos na en dey take dem go war and bring dem back.


E tell am, “Make yu nor fear, bikos my papa hand nor go fit tosh yu at-all. Yu go rule Israel and I go dey by yor side. Even my papa know sey na so e go bi.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ