2 Naw, all di great and wonderful tins wey e do, with how e take promote Mordekai, dem rite dem for Media and Persia kings book.
Evry oda tin wey Solomon do; en works and wisdom, dem rite dem for Solomon history book.
Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.
Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book.
Dem kon shek well and dem fine out sey wetin Mordekai tok, na true, so dem kon hang di two men. Dem rite all wetin happen so for di king rekord book.
Thru-out dat nite, di king know fit sleep, so e sey make dem bring di ofisas rekord book for di kingdom kom, den dem kon bring and read am for am.
Mordekai wear royal garment wey dem make with purpol and white, with one fine crown kon komot from di king present.
Den di king remove en ring (di one wey e take back from Haman) kon gi-am to Mordekai. And Estha sey make Mordekai kare for Haman propaty.
Dem kon know Mordekai for evriwhere, bikos en pawa for di palis, dey strong evriday.
My God, Yu don give mi wetin go protet mi. Yor rite hand dey support mi and I don dey strong, bikos of di way wey Yu dey help mi.
So di king give Daniel high post with many fine gifts. E gi-am pawa for evry aria for en kingdom kon make am leader ova all di wise men for Babilon.