18 And before today go end, di ofisas for Persia and Media wifes go hear dis tin wey Kween Vashti do so and dem nor go ever respet and fear dia husband again.
Evry woman for di kingdom nor go kon dey respet dia husband again wons dem hear sey, ‘King Zazes koll Kween Vashti make e kom meet am, but di kween nor gri go.’
“So if my king go like am, make yu kommand sey make Vashti nor ever kom near di king again. Make yu let us rite am put for Persia and Media law, so dat dem nor go ever fit shange am. Den yu go give en place as kween to anoda betta woman.