Ekklesiastes 9:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
9 So as far as wi dey live dis yuzles life wey God give us, make wi enjoy am with awa wife, bikos dat na awa reward for all di trobol wey wi dey face for dis world.
I dey get anytin wey I wont and I nor stop mysef from anytin wey go make mi happy. I dey proud for evritin wey I don work for and na all dis, bi my reward.
So I si sey, di best tin to do as human being, na to enjoy wetin wi don work for. Dat na di rizin why wi dey here, bikos nobody go fit bring us kom enjoy life again afta wi don die.
I still don notis one tin, at least, dis one dey good: E good for pipol to chop, drink and enjoy dia work for di short time wey God give dem to live dia life, bikos na so God wont am.
Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?
God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.