Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 9:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 9:7
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin make yu sey, ‘Di woman na my sista?’ Naw, I don take am as my wife! Make yu take di woman and make una komot for here!”


For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.


Party na to make pesin happy and to dey drink wine dey bring joy, but na money dey ansa evritin!


So if pesin get long life, make e dey happy as e dey live di life. But make e still know sey, di days wey darkness go dey, many well-well and evritin wey go still happen, dey yuzles.


I still don notis one tin, at least, dis one dey good: E good for pipol to chop, drink and enjoy dia work for di short time wey God give dem to live dia life, bikos na so God wont am.


Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am, but wen sofa kom, make yu know sey e still kom from God too, bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.


So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.


Den, di priest go give dem as special gift to God; na holy ofrin for di priest, with di ram breast and leg, bikos na di priest own akordin to wetin dem rite for di law. Afta dis, di Nazirite go fit drink wine.’


Jesus kon tell am, “Since yor faith strong rish to tok like dis, make yu dey go. Di demon don komot from yor pikin body.”


But make una from una heart give to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klean for una.


Jesus kon tell am, “Make yu go house, yor pikin nor go die.” Di man bilive wetin Jesus tell am, so e kon komot go en house.


but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


Wen Boaz don chop beleful, e kon go sleep for di end for where dem gada di rice put. Den Rut small-small waka go der, open en leg kon sleep near am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ