Ekklesiastes 9:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
5 Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.
One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
Bikos both wise and foolish man, go die and time dey kom wen dem nor go remember di wise pesin just as dem nor go remember di foolish pesin again! So one day, pipol go forget di two of dem.
E betta to go house where dem for dey kry dan to go where dem for dey celebrate; bikos evribody go die one day. So make pipol wey still dey alive put dis one for dia mind.