Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.