16 So I kon si sey, wisdom betta pass pawa, but nobody go respet wise man wey poor; nobody go gri listin to en advise bikos e nor get money.
Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol.
Wise pesin go fit take town wey strong men dey guide kon distroy di wall wey bi dia hope.
To dey wise, betta pass to dey strong! Yes, wisdom betta pass pawa.
Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.
Yu go nid to use more pawa take kut wood if di axe wey yu dey use nor sharp, so make yu sharp di axe well. Dis na di value wey dey wisdom and e go help yu susid.
Wisdom and money fit give yu anytin wey yu wont for life, but na only wisdom fit save yor life.
Pesin wey wise, strong pass ten pipol wey dey rule di town,
So wisdom dey good pass swod, but one sin fit distroy many-many good tins.