Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 9:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 9:12
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


bikos God fit distroy dat kind pipol wons and who know di wahala wey God and di king fit kause for dem?


Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.


Bikos of dis, dem nor go know before wahala go kom meet and distroy dem finish.


Na di same tin go happen to pipol and animal; di two of dem must die. So pipol nor betta pass animal. Dis tin dey yuzles too.


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


Wi nor fit kontrol breeze or tok di day wen wi go die. Dat na one war wey wi nor fit run from and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.


Dis na anoda tin wey I don si about wisdom and I like am, bikos of di way tins dey happen for dis world.


Anybody wey run from di wahala go fall for di pit and anybody wey won eskape from di pit, di trap go katch am, bikos wahala like heavy rain go fall from heaven and di eart foundashon go shake.


So na dis sin go distroy una. Una go bi like high old wall wey don krack and wey go soon fall and na wons e go fall.


Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.


But as dem dey waka up-and-down, I go trow net wey go katch dem like bird. I go ponish dem for di evil tins wey dem don do.


Na di profet dey wosh ova Israel for God. But anywhere wey e go, una dey won katch am like bird. Even for God house, all di pipol hate am.


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house.


Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ