Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 9:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 9:11
35 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.


Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.


Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


Awa strong enemies don skata. Dem don sleep kon die go like dat, so nobody go fit fight us again.


Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,


So I kon sey, make I try know di difrence between wisdom and foolishness. Abi e get anytin wey who take-ova from mi won do, wey I nor do before.


Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.


Den I tell mysef, “E nor go tey before God go judge evribody, bikos of evritin wey dem don do! Both good and bad pipol.”


Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Make yu asept di way God kreate tins; abi e get who go fit strait wetin God don bend?


Weda wi dey raitious or wiked; good or bad; dey klean or not; dey offa sakrifice or not, na di same tin go happen to all of us, bikos pesin wey good nor betta pass sina and pipol wey dey make promise give God, nor betta pass doz wey nor dey make.


Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.


Even di sojas wey sabi run well-well, nor fit eskape. Wen dem run rish di nort side for Eufrates River, dem stagga kon fall.


Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa or sey una strong well-well for war?


God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’


Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.”


Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.


David win di Filistia man with di katapault and stone. E shot di Filistia man fall kon kill-am. David nor even get swod for en hand.


But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ