Naw, make una serve God with all una heart and soul. Make una start to build di temple, so dat una go fit put di Kovenant Box and all di holy tins wey dem take dey serve God, for inside.”
David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.
I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
For en friends and Samaria pipol front, e kon sey, “Wetin dis yeye Jew pipol tink sey dem dey do? Dem one build di town again? Dem tink sey, na to offa sakrifice dem go take build di town finish one day? Dem go fit make stones from di ashes of di tins wey fire burn?”
So, make yu go plant yor seed for morning and nor stop to work until evening; bikos yu nor know di one wey yu do wey go bring gain for yu; weda na dis one, dat one or di two.