Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 8:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Wi nor fit kontrol breeze or tok di day wen wi go die. Dat na one war wey wi nor fit run from and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 8:8
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.


As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.


Yu know as human being life bi from di biginnin. Even di nomba of dia days wey dem go live, Yu don setol am and Yu nor dey shange.


If God remove di breath wey dey give us life,


Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa.


Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.


Wikedness nor dey pay pesin, but nor-tin dey shake good pipol.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


Who go fit show sey, wen pesin die, en spirit dey go up, but wen animal die, na groun en spirit dey go?


But wiked pipol nor go prosper, bikos dem nor dey fear God. Dia life go kwik finish like pesin shadow.


True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.


Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.


Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.


Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’


Wen dem beri dis body, e dey weak and go rotin, but wen God don raiz us up from deat, di body go kon dey fine and strong forever.


True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.


Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ