But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.
Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?
Small shidren nor go die again and evribody go get long life. Even wen pesin don rish hundred years, dem go sey e still dey yong. If dem die before dat time, e go bi sign sey, I ponish dem.