God pass en front kon sey, “Na mi bi Oga God. I bi God wey get mesi and pity; I nor dey kwik vex; just as I big na so too my love big rish and I nor dey fail.
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
Even if Yu sorry for wiked pipol, dem nor go still learn how to do wetin dey rite and even for where raitious pipol dey rule, wiked pipol still dey do wiked tins; dem nor dey si God glory wey dey kom.
God sey, “Moab pipol dey always stay for peace and dem neva ever karry dem go do slave work. Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun; wine wey dem nor dey pour from cup to cup. Yes! Di wine still sweet and en taste still good as e bi before.