Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.
Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.
Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.
Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,
Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.
Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”