3 E betta make pesin dey tink about life, dan sey e dey laf anyhow. Bikos to dey tink and dey kwayet, good well-well for di heart.
I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways, but naw, I dey obey yor word.
My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.
I still si sey, “E dey foolish to dey laf anyhow and to dey find enjoyment waka, nor dey make pesin get any betta tin!”
Pesin wey always dey tink about happiness, na fool, but pesin wey get sense, go still dey tink about deat too.
E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”
Make una happy, una wey dey hongry, bikos una go beleful. Make una happy, una wey dey kry naw, bikos una go laf.
Curse dey una head, una wey don ova beleful, bikos una go hongry. Curse dey una head, una wey dey laf naw, bikos una go kry well-well.
Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world.