27 Di Tisha sey: “I undastand all dis tins wen I dey try to look for ansa to evritin.
Mi wey dey tish una, I bi king for Israel and I stay for Jerusalem
I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.
“Wetin I dey find since, I neva still si am; I si sey among 1,000 pipol, na only one man dey good, but I nor si any woman wey good among dem.