24 Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand; dem too deep for us to tink about.
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.
Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!
Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.
I notis sey nobody go fit know evritin wey God dey do for dis world. Aldo wise pipol fit klaim sey dem know, but dem nor know anytin at-all.
Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!