Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 7:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 I dey always try my best make wisdom guide wetin I dey tink and evritin wey I dey do. Den I tell mysef, “I dey ready to learn” but I nor fit undastand am at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 7:23
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

bikos God know sey wen una chop from di tree, una eyes go open and una go bi like God ensef, wey know wetin dey good or bad.”


So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,


God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.


bikos yu know for yor own heart too, how many times yusef don curse oda pipol.


I notis sey nobody go fit know evritin wey God dey do for dis world. Aldo wise pipol fit klaim sey dem know, but dem nor know anytin at-all.


Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;


Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ