22 bikos yu know for yor own heart too, how many times yusef don curse oda pipol.
“Yu know all di wrong tins wey yu do David, my papa. Naw, God go ponish yu.
So, make yu nor listin to wetin pipol dey tok, if not, yu go hear yor savant dey curse yu,
I dey always try my best make wisdom guide wetin I dey tink and evritin wey I dey do. Den I tell mysef, “I dey ready to learn” but I nor fit undastand am at-all.
Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.
Na di tongue wi take dey praiz awa Papa and Oga God Jesus Christ and naim wi still dey use take curse pipol wey God kreate like ensef.