8 So, how wise pipol take betta pass pipol wey bi fool? Poor pesin wey sabi work well-well, wetin e go gain for dis life?
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.
I dey waka for God present as I dey for dis world!
E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.
Di more yu get, di more pipol go kom help yu spend am; di only gain for inside, na sey yu get money.
So, make yu enjoy wetin yu get, instead of wetin yu wont and stop to dream of tins wey dey yuzles, like pesin wey dey porshu breeze.
Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.