5 E nor ever si day lite or know wetin life bi, but at least, e get rest
“Na short life na-im man wey woman born get and na trobol full am.
Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka! Make dem bi like pikin wey dem just born, wey nor ever si sun before e die!
Lite sweet well-well and e dey good to si anoda new day.
But di ones wey dia own betta pass, na shidren wey dem neva born, bikos dem neva si all di wiked tins wey dey happen for dis world.
E for betta sey dem nor born dat pikin, bikos en life disappear enter darkness. E nor even get name.
pass di man wey stay 2,000 years for dis world and e nor ever enjoy am. Afta all, di two of dem dey go di same place.