Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 6:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 6:2
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Tins wey yu nor ask for, I go still give dem to yu. Till yu go die, yor propaty and respet go plenty pass di ones wey any king go ever get.


God make all di nashons dey sopraiz for Solomon, bikos E gi-am glory wey pass any oda king wey don rule Israel before am.


E die wen e don old well-well. E get many propaty and evribody dey respet am. Solomon en pikin kon take-ova from am as king.


God tell Solomon, “Yu nor ask for money, propaty and honor, or pawa to revensh yor enemies or for long life, instead yu ask for wisdom and undastandin, so dat yu go fit rule my pipol well;


My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.


Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about.


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!


E get anoda sirious problem wey I don si for dis world. Pesin money fit bring wahala for am.


Dis one too na anoda sirious problem. Just as pesin take kom, na so too e go take go back. And dia hard work na for nor-tin, e just bi like wen yu dey try to katch breeze.


I still don notis one tin, at least, dis one dey good: E good for pipol to chop, drink and enjoy dia work for di short time wey God give dem to live dia life, bikos na so God wont am.


E still good wen God bless yu with money, propaty and good health wey yu go take enjoy dem. To enjoy yor work and asept di life wey God give yu, na big gift from God.


Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.


Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw.


Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty.


and dem nor know sey na dis trust wey dem get for strenjas, distroy dia pawa. And naw, wahala dey kom, but dem nor know.


Strenjas go kom chop di plants wey una sofa plant and dem go opress una still una die.


Di strenjas wey dey among una go dey strong well-well, while una go dey weak evriday.


Wen wi rish der, una go si sey di pipol dey leave eazy life. Di land big well-well and e get evritin wey pesin wont. God don gi-am to us.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ