Ekklesiastes 6:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?
Awa Oga God! Yu know sey wi dey pass thru dis world like strenjas, just as awa grand-grand papa dem do. Awa days bi like shadow wey dey fade and wi nor fit run from deat.
I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.
So I si sey, di best tin to do as human being, na to enjoy wetin wi don work for. Dat na di rizin why wi dey here, bikos nobody go fit bring us kom enjoy life again afta wi don die.
Evritin wey dem do wen dem still dey alive, weda dem love, hate or bin dey jealous pesin, all don die follow dem go. Dem nor get part for anytin wey dey happen for dis world again.
So as far as wi dey live dis yuzles life wey God give us, make wi enjoy am with awa wife, bikos dat na awa reward for all di trobol wey wi dey face for dis world.