Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 6:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Evritin wey dey happen, na wetin God don sey go happen and all of us know sey, yu nor go fit argue with pesin wey strong pass yu.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 6:10
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God koll di man kon sey, “Where yu dey?”


Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?


“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”


If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.


Awa days for dis world bi like grass; just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine, but small time wi go die.


Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Wetin dey happen naw, don happen before and wetin go happen for future don still happen before, bikos God dey make di same tin happen again and again.


Bikos di more pesin dey argue, di more en word nor dey mean anytin, so how dat one go take benefit anybody?


“Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?


Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ