Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 5:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Dis one too na anoda sirious problem. Just as pesin take kom, na so too e go take go back. And dia hard work na for nor-tin, e just bi like wen yu dey try to katch breeze.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 5:16
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pesin wey bring trobol kom meet en family, nor go get anytin and foolish men go always bi savant to wise pipol.


Wetin pipol dey gain from all di hard work wey dem dey do for dis world?


But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.


So, wetin pipol really dey gain for all di hard work wey dem do?


E get anoda sirious problem wey I don si for dis world. Pesin money fit bring wahala for am.


Instead make wi born pikin, na breeze awa pain born. Wi neva win anytin and wi nor get shidren wey go take-ova awa world.


Una priests nor even ask sey, ‘Where Oga God dey?’ Doz wey dey tish my law nor even know mi. Una rulers don turn from mi. Una profets dey profesai with Baal name and una leaders dey woship juju wey nor fit help or save dem.


Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.


Wetin pesin go gain if e get di whole world and e luz en soul?


Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”


dey obey dis leaders and doz wey dey follow una do God work.


Make una nor bigin follow tins wey nor mean anytin, tins wey una nor go gain from or tins wey nor fit save una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ