15 Just as pesin kom out from en mama belle naked, na so too e go-go back naked and e nor go karry anytin follow body.
Den e sey, “Dem nor born mi with anytin and wen I die, I nor go karry anytin follow body. Na God dey give and E don take. Make wi praiz God name!”
“Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?
Bikos wen dem die, dem nor go take anytin follow body. Dia money and evritin wey dem get, nor go follow dem enter grave.
E go put am for bad business kon luz evritin. For di end, nor-tin remain to leave for en shidren.
Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.
“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
Bikos wi nor bring anytin kom dis world and true-true, wi nor go take one singol tin komot from dis world afta wi don die.