Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 5:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Pipol wey like money, even di one wey dem get, nor dey rish dem and doz wey like propaty, wetin dem get, nor dey rish dem too. Dis kind behaviour dey yuzles too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 5:10
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?


“Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”


So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon! Nor put hope for wetin yu tif! If yor money many, make yu nor too happy.


So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,


All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.


I dey get anytin wey I wont and I nor stop mysef from anytin wey go make mi happy. I dey proud for evritin wey I don work for and na all dis, bi my reward.


But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


Na di same tin go happen to pipol and animal; di two of dem must die. So pipol nor betta pass animal. Dis tin dey yuzles too.


Even doh many pipol dey support am naw, anoda generashon go grow kon rijet am leta. So yu si, evritin dey yuzles and e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.


E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!


Na evribody dey enjoy wetin di land dey produce; even king dey put hope for wetin dem harvest from farm.


Pipol dey work just bikos of wetin dem go chop, but dem still nor dey beleful.


“Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem.


“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.


Den Jesus tell dem, “Make una guide against long-trot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am.”


Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ