Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.
As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.
Den Hazael kon go visit Elisha. E karry gift and forty kamel wey full with all di fine-fine tins wey dey Jerusalem follow body. Wen e rish der, e stand for di profet front kon sey, “Na yor pikin, King Ben-Hadad for Siria send mi kom ask yu sey, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep.