Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 3:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Time dey to kry and time dey to laf; time dey to mourn and time dey to dance.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 3:4
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Sarah kon sey, “God don make mi laf. Evribody wey hear wetin don happen, go follow mi laf.”


As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.


Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,


Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


Time dey to skata stones and time dey to gada dem again; time dey to embrace pesin and time dey not to embrace pesin.


Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am, but wen sofa kom, make yu know sey e still kom from God too, bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.


Awa God sey, “Make yu konfort my pipol! Konfort dem well-well!


Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.


“ ‘Wi blow flute for una, but una nor gri dance, wi dey kry for awa pesin wey die, but una nor follow us kry.’


Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.


En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.


Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.


Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am.


Make una kry and make sorrow dey una heart, den una go show sey una nor dey happy.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ