One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.
Bikos both wise and foolish man, go die and time dey kom wen dem nor go remember di wise pesin just as dem nor go remember di foolish pesin again! So one day, pipol go forget di two of dem.
E betta to go house where dem for dey kry dan to go where dem for dey celebrate; bikos evribody go die one day. So make pipol wey still dey alive put dis one for dia mind.
True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.
Weda wi dey raitious or wiked; good or bad; dey klean or not; dey offa sakrifice or not, na di same tin go happen to all of us, bikos pesin wey good nor betta pass sina and pipol wey dey make promise give God, nor betta pass doz wey nor dey make.