Yong man, make yu happy as yu dey yong! Make yu enjoy evry minute for dis life and do evritin wey yu won do; but remember sey yu go tell God evritin wey yu dey do.
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
Di nashons dey vex, but di time wey yu go ponish dem, don rish. And na naw yu go judge doz wey don die kon reward yor savants; di profets; doz wey dey good and evribody wey dey fear yor name, both small and big. Dis na di time to distroy doz wey dey kause wahala for di eart.”