Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 3:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 So, make pipol chop, drink and enjoy wetin dem work for, bikos all dis tins na God gift.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 3:13
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure.


E get anybody wey won live betta life? Anybody like to get long life?


So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God.


I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.


God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.


So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.


So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


Afta una don woship am, una go celebrate bikos of all di good tins wey di Oga una God don give una and una family, di Levi and di strenjas wey dey stay among una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ