“Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
I dey get anytin wey I wont and I nor stop mysef from anytin wey go make mi happy. I dey proud for evritin wey I don work for and na all dis, bi my reward.
I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.
So I si sey, di best tin to do as human being, na to enjoy wetin wi don work for. Dat na di rizin why wi dey here, bikos nobody go fit bring us kom enjoy life again afta wi don die.
Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?
God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.
So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.
Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.
For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).
Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.