But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.
E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!
So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.
“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.