And who go fit know weda di one wey go kom afta mi go dey wise or foolish? But dem go kontrol evritin wey I work for, for dis world! So, make una si as evritin dey yuzles!
Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.